Maduka Okoye: How Super Eagles goalkeeper become centre of attention for Nigerians

Maduka Okoye

Wia dis foto come from, Maduka Okoye

"I no fit wait to see Maduka Okoye on top my screen today," dis na comment wey one of di female fans of di Super Eagles goalkeeper post ontop social media ahead of Nigeria game against Guinea Bissau.

Di Super Eagles dey face Wild Dogs of Guinea Bissau for Match Day three of di 2021 Africa Cup of Nations for di Stade Roumdé Adjia in Garoua, Cameroon on Wednesday.

Di Eagles dey top of Group D afta dia 1-0 win over Egypt on Tuesday and 3-1 win over Sudan last Saturday.

If dem win, dem go be di first team to gada nine points from di group stage of di 2021 Afcon tournament.

As football fans for Nigeria dey anticipate di performance of di Eagles for Wednesday match, di man wit di number one jersey, Maduka Okoye na di main focus for many female fans.

One twitter user say dis na anoda day plus opportunity for Nigerian ladies to crush on Maduka Okoye.

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Di super eagles goalkeeper wey dey make im first appearance for major tournament dey totori millions of Nigerians, Africans, most especially women probably because of im looks and im football skills.

E begin trend among female fans afta e post foto of imsef afta dia first game for Afcon tournament against di Pharaohs of Egypt wey dem win 1-0.

E share di foto wit di caption 'Onto di next one'

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post

Di post don since gada almost eighty thousand likes, ova seven thousand retweets and thousands of comments most especially female fans.

Check out some of di tins wey dem dey tok about di Super Eagles shot stopper.

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Meanwhile some Twitter users feel say Okoye dey attract a lot of distraction.

"I hope di guy fit stay focus and help win dis game", na wetin one twitter user @ok_colzy tok.

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Tweet

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin to know about Maduka Okoye

Dem born di 22-year-old goalkeeper for Düsseldorf, Germany to Nigerian father and a German mama.

For 2019, im pledge im international future to Nigeria.

Okoye get im first call up to play for Super Eagles wen former coach Gernot Rohr invite am to di Nigerian national team setup and hand Okoye im debut for one high profile friendly game against five-time world champions, Brazil for October 2019. For di game Nigeria gbab impressive 1-1 draw against di Selecao.

Na for December 2021, Super Eagles Caretaker Coach Eguavoen shortlist am for 2021 Afcon Nations Cup as part of di 28-Man Nigeria Squad.

Maduka Okoye

Wia dis foto come from, Maduka Okoye

Okoye career start for Germany wia im play for di German football club, Fortuna Düsseldorf II as dia regular goalkeeper between 2017, 2018-2019 season.

For 2020, Maduka Okoye join Dutch professional football club, Sparta Rotterdam wia im don be dia number one.

Later for 2021, im agree to join Premier League club Watford on five-and-a-half year deal for undisclosed fee.

Okoye join Watford on 1 January 2022. Di deal see dem loan Okoye back to Sparta Rotterdam until di end of di 2021/22 campaign.