Got a TV Licence?

You need one to watch live TV on any channel or device, and BBC programmes on iPlayer. It’s the law.

Find out more
I don’t have a TV Licence.

Live Reporting

By Jelilat Olawale

All dem times wey dem write be UK

  1. Una bye-bye!

    Na here we go march break ontop our live coverage of di Nigeria presidential inauguration.

    Scroll back up to catch up on how di inauguration waka for Abuja and oda states.

    Thank you and bye-bye!

  2. 'I accept to do more for Delta State' - Sheriff Oborevwori

    Di new Govnor of Delta State Rt. Hin Sheriff Oborevwori don take im oath of office.

    E happun for di Stephen Keshi Stadium, Asaba Delta State.

    For im inaugural speech, Govnor Oborevwori promise to do more to advance di state to new heights in leadership and socio-economic development.

    Di govnor wey be di immediate past Speaker of di Delta State House of Assembly, say im gomemt go build on di achievements of di immediate past administration, thru meaningful development opportunities for all, realistic reforms and enhanced peace and security.

    "Di new administration go seek to foster sustainable economic growth and private sector job creation; boost human capital; build enabling infrastructure; enhance governance and accountability systems for improved service delivery; and strengthen public financial management."

    Govnor Oborevwori also promise to sustain di existing entrepreneurship development programmes and expand am to encourage creation of more small-scale businesses wey go create jobs and so reduce crime and anti-social activities among di vibrant youth population.

    E say e go also enhance di existing social investment programmes for di benefit of di poor and vulnerable groups, including widows and People Living with Disabilities, through microcredit, training, and business networking even as dem go develop empowerment programmes for women associations, particularly for rural areas and complete all ongoing projects - roads, bridges, schools, and oda physical infrastructure and build conducive environment for public-private partnership investments for all sectors of di economy.

  3. 'I promise to be govnor of all Rivers pipo'

    Karina Igonikon

    BBC Pidgin, Port Harcourt

    Siminialayi Fubara for di inauguration

    Di new govenor of Nigeria oil rich Rivers State, Siminalayi Fubara don promise to be govnor for all Rivers pipo.

    Fubara tok for im inauguration speech just afta e take im oath of office as govnor of di southern Nigerian state. E promise to provide strong and dedicated leadership.

    Mr fubara tok say im experience wey im gada from civil service, don make am dey ready for di work wey dey ground for im and im Deputy, Prof Ngozi Odu.

    "We no go abandon our youth but we go empower dem with skills and abilities. We believe in di job creation capacity of small and medium enterprises.

    "We go also construct di long planned Port Harcourt ring road and strengthen our healthcare system and ensure say our health systems dey functional so dat we fit deliver good and affordable health care." E tok.

    Fubara also promise to follow di footstep of di former governor Nyesom Wike, wey also be im political Godfather in promoting better and fast dilevery of justice in di state judiciary service and im go promote judicial autonomy.

    Anoda tin wey di govnor tok na say e promise to take steps to improve di smoothness of doing business for di state to attract foreign and local investors.

    Some of di dignitaries wey attend di ceremony na former govnor of Benue state, Samuel Ortom, former Govnor of Rivers state, Peter Odili and im wife, justice Mary Odili and many odas.

    Read more: 'I no regret anytin,' Wike tell BBC

  4. Sanwo-Olu take oath of office under heavy downpour

    Dem don swear-in Sanwo-Olu, and im deputy Femi Hamzat for a second term in office as first and second citizens of Nigeria commercial capital, Lagos State.

    Sanwo-Olu and im deputy don begin dia second term as govnor and deputy govnor of Lagos State afta Chief Justice Kazeem Alogba swear dem in on 29 May.

    Di inauguration happun for Tafawa Balewa Square inside heavy rain downpour, but despite di rain, party pipo, guests, tori pipo and odas bone di rain to witness di ceremony.

    Di immediate families of di govnor and im deputy grace di occasion in traditional attires just as party loyalists attend wit marching outfits to show dia support for dem.

  5. Fotos from Kano as Abba Kabir Yusuf take oath of office

    Abba during im oath taking
    Image caption: Abba as Justice Dije dey swear am in
    NNPP Presidential candidate Rabiu Musa Kwankwaso also attend
    Image caption: Former Kano govnor and political godfather of di new govnor, Rabiu Musa Kwankwaso
    Supporters inside Sani Abacha stadium wey host di swearing in
    Image caption: Supporters of Govnor Abba Kabir Yusuf with dia trademark red cap
  6. Di new govnor of Rivers state, Siminalayi Fubara

    First family of Rivers State
    Image caption: Di first family of Rivers State

    Siminalayi Fubara don take oath of office as di new govnor of Rivers State.

    E take di oath shortly after di Chief Judge of Rivers State, Justice Simeon Amadi administer di oath of office and allegiance on im deputy, Prof. Ngozi Odu for Yakubu Godwin Stadium, Port Harcourt.

    Prof. Odu na di second female deputy govnor for di state.

    Prof Ngozi Odu
    Image caption: Deputy Governor of Rivers State, Prof Ngozi Odu as she dey take her oath of office
    Sim Fubara
    Image caption: Sir Siminalayi Fubara na di new Governor of Rivers State
    Sim Fubara
    Image caption: Governor Siminalayi Fubara as e dey take im first official drive as Governor
  7. Why 'Black Monday' dey trend

    Some Nigerians on Monady dey share dia reactions for social media afta di Chief Justice Olukayode Ariwoola swear in President Bola Ahmed Tinubu for office.

    Wit di #BlackMonday some of di Nigerians for Twitter post different comments about di Inauguration Ceremony.

    Di Independent National Electoral Commission Inec, bin declare Bola Tinubu of di All Progressives Congress as winner of di 2023 presidential election afta one tight race wit oda political parties.

    Some contestants wey include Peter Obi of di Labour party and Atiku Abubakar of di PDP dey challenge di election result for court.

    View more on twitter
    View more on twitter
    View more on twitter
  8. BreakingPresident Bola Ahmed Tinubu first speech afta inauguration

    President Bola Ahmed Tinubu don give im first speech as di 5th democratically elected president of di Federal Republic of Nigeria.

    For di Eagle Square afta e take di oath of office, President Tinubu assure Nigerians say im administration go be for all Nigerians.

    “Our administration go only govern you but neva rule over you. We shall consult and dialogue but neva dictate. We shall reach out to all but neva pull down one single pesin sake of say e hold views wey dey contrary to our own.

    President Tinubu for im inaugural speech hamper on di kontri unity. E say everyone must come together as a pipo irrespective of dia creed, place of birth, or anywhere dem come from.

    On im part, e promise to serve Nigerians without prejudice as e promise to rule wit compassion and amity towards all.

    E assure Nigerians say di mandate dem give am no dey misplaced. “Di confidence dey there, hope don come back for Nigerians, make we just dey united.”

    Read more: Tinubu inaugural speech

  9. Post update

    Quote Message: We go consult and dialogue and never dictate. from Bola Ahmed Tinubu Nigeria President
    Bola Ahmed TinubuNigeria President
  10. Breaking'May history dey kind to you' - Tinubu to Buhari

    President Bola Tinubu don twale im predecessor, Muhammadu Buhari for im effort as Nigeria prresident.

    Tinubu for im inaugural speech after e don take oath of office say Buhari try im part and history go dey kind to am.

    Di former president don already dey on im way to Daura, im hometown wia e dey retire after eight years for office.

  11. Babajide Sanwo-olu take oath of office for di second time as Lagos govnor

    New official portrait of Lagos govnor Babajide Sanwo-Olu
    Image caption: New official portrait of Lagos govnor Babajide Sanwo-Olu

    Dem don swear-in Sanwo-Olu, Hamzat for second term

    Babajide Sanwo and im deputy Obafemi Hamzat don begin dia second term as Govnor and Deputy Govnor of Lagos State afta Chief Justice Kazeem Alogba swear dem in on 29 May.

    Di inauguration happun for Tafawa Balewa Square amidst heavy downpour, but despite di rain, party pipo, guests, tori pipo and odas defy di rain to witness di ceremony.

    Di immediate families of di Govnor and im Deputy grace di occasion in traditional attires just as party loyalists attend wit marching outfits to show dia support for di duo.

    Di swearing-in dey come afta di Independent National Electoral Commission (Inec) declare Babajide Sanwo-Olu of di All Progressives Congress winner of di March 18 and 19govnorship election.

    Sanwo-Olu score 762,134 votes to beat im closest rival Gbadebo Rhodes-Vivour of Labour Party wey get 312,329 votes.

    Di APC candidate win 18 out of di 20 local goment areas of Lagos State.

  12. Fotos: pomp and pageantry meet tradition

    Presidential Inauguration
    Image caption: Presidential Inauguration

    Dis na fotos from di Inauguration ceremony wey shelle for Abuja some moments ago.

    Bola Ahmed Tinubu become di fifth democratically elected president for Nigeria.

    Religious leaders, traditional rulers and oda important pipo follow witness di event for Eagles Square Abuja

    Pipo carry instrument
    Image caption: Di military band during di residential Inauguration
    traditional rulers siddon
    Image caption: Oluwo of Iwo land wit oda traditional rulers
    Tinubu dey waka wit odas
    Image caption: Bola Tinubu dey wave hand for Eagles Square Abuja
    Coat of arm, tent and oda tins
    Image caption: Podium for Eagles Square during di presidential Inauguration
    Presidential Inauguration
    Image caption: Police officers for di presidential Inauguration
    pipo wit turbans sidon
    Image caption: Northern leaders for di Presidential Inauguration
    Military pipo dey match
    Image caption: Match past for di Presidential Inauguration
    Pipo siddon
    Image caption: Traditional rulers for di presidential inauguration
    pipo dey waka
    Image caption: Pipo for di residential Inauguration
  13. Moment Buhari comot for Eagle Square

    Muhammadu Buhari
    Image caption: Nigeria immediate-past president Muhammadu Buhari

    Dis na di moment former President Muhammadu Buhari comot Eagle Square afta e hand ova power give di new President Bola Tinubu.

    Di former Nigerian leader wit im wife Aisha Buhari, dey go im hometown Daura for Katsina state afta e don serve Nigeria for eight years.

    For di Nnamdi Azikwe airport before im plane comot, di former president wave bye-bye to kontri pipo.

    Ministers of Labour, Chris Ngige, Humanitarian Affairs, Sadiya Faruk, FCT, Mohammed Bello dey among odas wey bin wait for di Nnamdi Azikiwe International Airport to wave bye-bye to former president Buhari.

    On Sunday, di Oga Buhari for im farewell message to Nigerians as di 4th democratically elected president since Nigeria return to democracy for 1999, say e dey confident say e dey leave di kontri better for 2023 dan e meet am for 2015 when e enta office.

    Di 80-year-old say e dey fulfilled say im goment don begin ''Nigeria Re-Birth by taking di initial critical steps and I dey convince say in-coming administration go fast di pace of dis walk to see a Nigeria wey fulfil im destiny to be a great nation.''

    View more on twitter
  14. Challenges wey dey face President Bola Tinubu

    President Bola Tinubu
    Image caption: President Bola Tinubu

    Dem don swear-in di new president of Africa largest democracy, Nigeria for one ceremony for di kontri capital, Abuja.

    71-year-old Bola Tinubu win di February election wit a promise to renew hope - but e dey face tough economic and security challenges.

    E take over from two-term President Muhammadu Buhari for di middle of high inflation rate, record debt levels and increasing cases of kidnap-for-ransom.

    Two closest rival of oga Tinubu for di election dey challenge im victory for court.

    Dem say di outcome dey manipulated.

    But di immediate-past president, wey no contest for di election afta eight years in power, say di results dey "credible" and di vote dey "fair and transparent".

    Dignitaries from across di continent attend di swearing-in ceremony for di capital, Abuja, wey reflect di significance of di event.

    Oga Tinubu fit get little time to celebrate. Nigerians dey expect swift action.

    Inflation dey run at its highest rate for nearly 18 years, one in three pipo dey unemployed and di output of di oil industry wey dey important for di kontri economy dey shrink.

    E gatz move quickly to convince pipo wey no vote for am say im dey up to di task.

    Read more: Di five test wey dey wait Tinubu.

  15. Wike arrive in style for Siminalayi Fubara inauguration as govnor of Rivers State

    Nyesom Wike

    Di outgoing govnor of Rivers state, Nyesom Wike don arrive di arena of di inauguration of di incoming govnor for Portharcourt, di state capital.

    Di govnor immediatley take salute for di police guard wey don already tanda for di venue. E den enter di Motorcade wey dey already wait for am to move round di stadium as plenty pipo dey ginger am.

    Nyesom Wike
  16. Rivers govnor-elect dey take oath of office despite heavy rainfall

    Vehicle
    Image caption: Di parade vehicle dey ground to carry di new Governor

    Di swearing in ceremony of di Governor -elect and Deputy Govnor-elect of Rivers State dey go on for di Yakubu Godwin stadium despite heavy rainfall.

    Chief Judge of di State, Justice Simeon Amadi go administer di oath of office on Sir Siminialayi Fubara as Governor and Prof. Ngozi Nma Odu as Deputy Governor.

    Sir Siminialayi Fubara dey take over from Nyesom Wike as di fourth elected govnor of Rivers State since 1999.

    Former Governors of Rivers State since di return to democratic rule for 1999 include:

    Dr. Peter Odili:1999 to 2007

    Rt. Hon. Chibuike Rotimi Amaechi: 2007 to 2015

    Nyesom Wike: 2015 to 2023

    Military formation
    Image caption: Military formation dey on standby
  17. Stage fall as Kano state govnor inauguration dey go on

    Kano state inauguration stage collapse
    Image caption: Kano state inauguration stage collapse

    Di stage for Sani Abacha stadium wia di swearing-in ceremony for Kano state govnor bin collapse as di event dey happun.

    Di new govnor Yusuf Abba, im deputy plus di state acting Chief Judge, Dije Aboki bin dey on di podium.

    Local media, Channels TV report say all di pipo wey dey di podium dey safe.

    View more on twitter
  18. Dem don swear in Abba Kabir Yusuf as new Kano govnor

    Govnor Abba Kabir Yusuf during im swearing in
    Image caption: Govnor Abba Kabir Yusuf as Justice Dije dey swear am in

    Na around 10:40am di new Kano state govnor Abba Kabir Yusuf collect im oath office wey di new chief judge of di state Justice Dije Aboki adminster to am.

    Di Sani Abacha stadium wia di event happun full with pipo many of dem with red caps wey be symbol of di Kwankwasiyya movement wey di new govnor belong to.

    For di brief speech wey Abba Kabir give e tok say e dey thank Kano pipo as dem believe in am and go do im best to give di state a new direction.