Fotos: How Prince Harry and Meghan Markle three-day visit to Nigeria waka

Harry and Meghan dey waka

Di Duke and Duchess of Sussex visit Nigeria on a three-day trip.

Prince Harry and Meghan bin dey invited by di kontri chief of defence staff to meet injured service personnel as part of dia work with di Invictus Games.

Di trip start on Friday and end on Sunday.

See how e waka.

Prince Harry and Meghan dey welcomed by a crowd

ON FRIDAY

As dem land Nigeria on Friday, Prince Harry and Meghan meet wit di Chief of Defence Staff, Christopher Musa.

One of dia first activities dem do na a visit to one school for Abuja wia dem attend one event on mental health for students.

Dem dey welcomed by school children – as dem take dia seats to open a meeting on mental health. Na issue di Prince wey dey close to di Prince heart.

For dia, Harry tell di students say "e dey OK if you no dey OK."

E also tell dem make dem no keep quiet if dem see dia colleagues dey pass through something.

Harry and Meghan for di school
Wetin we call dis foto, Prince Harry tell students say "e dey Ok if you no dey OK"

Visit to Kaduna state

Prince Harry also on Friday go Kaduna wia im meet wit Govnor Uba Sani.

For Kaduna, Govnor Sani present paintings to di Prince and one of dem na of Harry and im wife on dia wedding day.

Dem also give di Prince a traditional decorative pillow called “tuntun” for Hausa.

Im visit some sojas wey don injure for dia line of duty.

Prince Harry and Govnor Uba Sani
Wetin we call dis foto, Prince Harry also on Friday go Kaduna wia im meet wit Govnor Uba Sani.
Kaduna Govnor present paintings to Prince Harry
Wetin we call dis foto, Prince Harry receive paintings from Kaduna state govnor
Prince Harry wear northern outfit
Wetin we call dis foto, Prince Harry wear agbada for Kaduna, wey be northern outfit

ON SATURDAY

Prince Harry and Meghan, on Saturday on DI second day of DIA three day visit to Nigeria meet wounded soldiers wey go represent di kontri for next year Invictus Games for Canada.

For di Armed Forces Recreation Centre for Abuja, Prince Harry team wey dey dressed in yellow play inside one exhibition against a team led by Nigeria defence chief– General Christopher Musa.

Dem siddon play di volleyball match with army veterans, most of wey dey wounded in battle against di kontri Islamist insurgency.

For di Duke team na former Nigerian soldier Peacemaker Azuegbulam, wey lost im leg in combat against Boko Haram.

E later become di first African to win gold for di Invictus Games for Germany last year.

Former army captain wey serve as helicopter pilot for Afghanistan, Prince Harry found Invictus Games for 2014 to promote rehabilitation of wounded soldiers through sports.

During di volleyball game for Abuja
Prince Harry play volleyball with wounded soldiers

SUNDAY

For dia final official day for Nigeria, Prince Harry and Meghan Markle visit Ilupeju Junior Grammar School, Lagos, wia dem watch one basketball practice and Harry join for some drills.

Di couple use di occasion to unveil one partnership between dia Archewell Foundation and non-profit Giants of Africa, wey dey use sport to empower young pipo.

Prince Harry and Meghan on dia last day for Nigeria
Prince Harry and Meghan greet di children wit smile
Wetin we call dis foto, Prince Harry dey display for di children
Prince Harry and im wife stand to address di children for Lagos
Wetin we call dis foto, Prince Harry and Meghan dey address di children for Lagos
Prince Harry dey tok to one little girl ontop wheelchair wey hold basketball

Di Invictus Games dey for im 10th Anniversary dis year and Nigeria first take part in di games in 2023 for Düsseldorf in Germany.

Dis make Team Nigeria di first African nation to dey represented in di international sporting event.

Di 'Invictus Games' na sporting tournament wey involve different kind of sports for sojas wey get injury or dey wounded in di course of dia service.

Both serving and retired servicemen fit take part in di games.

Prince Harry bin dey motivated to start di events afta im witness di 'Warrior Games' for America in 2013, and experience how sports fit help in physical and psychological healing.

'Invictus' na latin word for 'unconquered'.

Prince Harry and Meghan during di volleyball game for Abuja
Wetin we call dis foto, Prince Harry and Meghan dey Nigeria sake of di Invictus Games