Kehinde Bankole and Wale Ojo win Best Actress and Best Actor, Breathe of Life win best movie for 2024 AMVCA

Wale Ojo and Kehinde Bankole win Best Actor and Actress

Wia dis foto come from, Instagram/WaleOjo/KehindeBankole

Wetin we call dis foto, Wale Ojo and Kehinde Bankole

Nigerians Kehinde Bankole and Wale Ojo na im win Best Actress and Best Actor, while Breathe of Life win best movie for dis year AMVCA 2024 awards.

Dem defeat oda ogbonge actors and movies to win di awards dis year.

Di Africa Magic Viewers' Choice Awards (AMVCA) na di ogbonge awards event for movies and actors for Africa.

Di 2024 edition of di AMVCA wey happun on Saturday na di 10th edition and e bring togeda plenti celebrities for di entertainment industry.

AMVCA na like di ‘Oscar’ of Nigeria and di award get several categories wey dem dey nominate actors and movies including crew members wey dey outstanding.

Full list of 2024 Nominees and Winners

Trailblazer Award

  • Chimezie Imo WINNER

Industry Awards

  • Esther Idowu Phillips (Iya Rainbow)
  • Richard Mofe Damiji (RMD)

Best Digital Content

  • National Treasure - Adebola Adeyela (Lizzy Jay)
  • Medical Negligence and Copyright Infringement - Isaac Ayomide Olayiwola (Layi Wasabi) WINNER
  • Hello Neighbour - Elozonam Ogbolu, Lina idoko and Jemima Osunde
  • The Boyfriend - Maryam Apaokagi-Greene

Best Indigenous Language Film (West Africa)

  • Mami Wata (CJ Fiery Obasi)
  • Jagun Jagun (Femi Adebayo) WINNER
  • Ijogbon (Kunle Afolayan)
  • Orisa (Odunlade Adekola)
  • Nana Akoto (Kwabena Gyansah)

Best Supporting Actor

  • Alexx Ekubo (Afamefuna)
  • Demola Adedoyin (Breath of Life) WINNER
  • Itele d Icon (Jagun Jagun: The Warrior)
  • Gregory Ojefua (This is Life)
  • Timini Egbuson (A Tribe Called Judah)
  • Levi Chikere (Blood Vessel)
  • Ropo Ewenla (Over the Bridge)

Best Supporting Actress

  • Joke Silva (Over the Bridge)
  • Fathia Williams (Jagun Jagun – The Warrior)
  • Bimbo Akintola (The Black Book)
  • Genoveva Umeh (Breath of Life) WINNER
  • Eliane Umuhire (Omen)
  • Tana Adelana (Ijogbon – Chaos)
  • Ejiro Onojaife (The Origin: Madam Koi Koi)

Best Lead Actor

  • Wale Ojo (Breath of Life) WINNER
  • Stan Nze (Afamefuna)
  • Marc Zinga (Omen)
  • Gideon Okeke (Egun)
  • David Ezekiel (Blood Vessel)
  • Richard Mofe Damijo (The Black Book)
  • Adedimeji Lateef (Jagun Jagun – The Warrior)
  • Gabriel Afolayan (This is Lagos)

Best Lead Actress

  • Segilola Ogidan (Over the Bridge)
  • Lucie Debay (Omen)
  • Omowunmi Dada (Asiri Ade)
  • Ireti Doyle (The Origin: Madam Koi Koi)
  • Adaobi L. Dibor (Blood Vessel)
  • Evelyne Ily (Mami Wata)
  • Kehinde Bankole (Adire) WINNER
  • Funke Akindele (A Tribe Called Judah)

Best Cinematography

  • Mami Wata (Lílis Soares)
  • Blood Vessel (Gideon Chukwu)
  • Over The Bridge (KC Obiajulu) WINNER
  • Breath of Life (Ola Cardoso)
  • Jagun Jagun - The Warrior (Adeoluwa Owu)
  • Ijogbon - Chaos (Adekunle Nodash Adejuyigbe)
  • Omen (Joachim Philippe)

Best Editing

  • Chuka Ejorh And Onyekachi Banjo (Over The Bridge)
  • Holmes Awa (Breath of Life)
  • Alex Kamau And Victor Obok (Volume)
  • Dayo Nathaniel (Ogeere - Earth)
  • Antonio Ribeiro (The Black Book) WINNER
  • Nathan Delannoy (Mami Wata)

Best Sound Design

  • Ava Momoh (Over the Bridge)
  • Daniel Pellerin and Amin Bhatia (Kipkemboi)
  • Grey Jones Ossai x2 (Breath of Life and Blood Vessel) WINNER
  • Samy Bardet (Mami Wata)

Best Art Direction

  • Blood Vessel (Victor Akpan)
  • Over The Bridge (Abisola Omolade) WINNER
  • Breath of Life (Okechukwu Frost Nwankwo, Kelechi Odu)
  • The Black Book (Pat Nebo and Chima Temple)
  • Jagun Jagun: The Warrior (Tunji Afolayan)
  • Mami Wata (C.J Fiery Obasi)
  • Omen (Eve Martin)

Best Costume Design

  • Demola Adeyemi (Over The Bridge)
  • Bolanle Austin Peters, Ituen Basi, Folake Coker and Clement Effanga (Funmilayo Ransome-Kuti)
  • Lola Awe (Jagun Jagun: The Warrior) WINNER
  • Bunmi Demilola Fashina (Mami Wata)
  • Daniel Obasi (Breath of Life)

Best Makeup

  • Francesca Otaigbe (Over the Bridge)
  • Campbell Precious (Mami Wata) WINNER
  • Hadizat Gambo (Mojisola)
  • Hakeem Onilogbo (Jagun Jagun – The Warrior)
  • Feyisayo Oyebisi (A Tribe Called Judah)

Best Writing TV Series

  • Skinny Girl in Transit (Season 7)
  • Wura (Season 2)
  • Visa on Arrival
  • MTV Shuga Naija
  • Volume- Mona Ombogo WINNER
  • Masquerades of Aniedo
  • Slum King

Best Writing in a Movie

  • Breath of Life (BB Sasore)
  • Over The Bridge (Tosin Otudeko)
  • Funmilayo Ransome-Kuti (Tunde Babalola) WINNER
  • Jagun Jagun: The Warrior (Adebayo Tijani)
  • Afamefuna (Anyanwu Sandra Adaora)
  • A Tribe Called Judah (Olufunke Ayotunde Akindele, Collins Okoh and Akinlabi Ishola)
  • Mami Wata (CJ Fiery Obasi)

Best Director

  • Moses Inwang (Blood Vessel)
  • Adebayo Tijani And Tope Adebayo (Jagun Jagun - The Warrior)
  • BB Sasore (Breath of Life) WINNER
  • Johnscott Enah (Half Heaven)
  • C.J. Fiery Obasi (Mami Wata)
  • Kayode Kasum (Afamefuna)
  • Tolu Ajayi (Over The Bridge)

Best Movie

  • Funmilayo Ransome-Kuti
  • Breath of Life WINNER
  • Over The Bridge
  • Blood Vessel
  • A Tribe Called Judah
  • The Black Book
  • Mami Wata

Best Documentary

  • Ormoilaa Ogol (The Strong One)
  • Lobola, A Bride’s True Price? WINNER
  • Empalikino (Forgiveness)
  • The Water Manifesto: Osun (Water for Gold)
  • Sowing Hope

Best Scripted Series

  • Volume
  • Wura (Season 2)
  • Slum King
  • Itura WINNER
  • Chronicles

Best Unscripted Series

  • Lol Naija (Season 1)
  • Nightlife In Lasgidi
  • The Real Housewives Of Lagos (Season 2)
  • Gh Queens (Season 2) WINNER
  • Mutale Mwanza Unscripted (Season 1)

Best Indigenous Language (East Africa)

  • Where The River Divides
  • Ormoilaa Ogol (The Strong One) WINNER
  • Wandongwa
  • Nakupenda
  • Itifaki

Best Indigenous Language (South Africa)

  • Service To Heart
  • Uncle Limbani
  • Motshameko O Kotsi WINNER

Best Multichoice Talent Factory Movie

  • Grown
  • Her Dark Past WINNER
  • Somewhere in Kole
  • Full Time Husband
  • The 11th Commandment
  • Mfumukazi

Best Scripted M-Net Original

  • Slum King WINNER
  • Half Open Window
  • Itura
  • The Passenger
  • Magic Room

Best Unscripted M-Net Original

  • What Will People Say
  • The Irabors’ Forever After
  • Nwuyee Bekee (Foreign Wives) WINNER
  • Date My Family Zambia
  • Royal Qlique (Season 2)

Best Indigenous M-Net Original

  • The Passenger
  • Nana Akoto
  • Apo
  • Irora Iya WINNER
  • Love Transfusion (Kiapo Cha Damu)

Best Short Film

  • T’egbon T’aburo
  • Broken Mask WINNER
  • Eighteenth Year
  • Man and Masquerades
  • A Place Called Forward

Wetin happun for AMVCA 2024

Di 10th edition of di AMVCA bin hold on Saturday 11th of May as voting for categories don end since April.

Dis edition begin wit red carpet wia celebrities go show diasef wit dia dresses and dem pepper diasef.

Dem begin show di event from 16:00 WAT (17:00CAT)- 4pm on Saturday, 11 May 2024 and na red carpet go start am.

By 7pm, dem move on to di main event wia dem begin unveil di winners for each categories.

Host

Na di ogbonge IK Osakioduwa host di AMVCA for di tenth time since 2013.

IK na presenter and TV host wey get enchanting voice and on Saturday, im host and celebrate ten years of shining a spotlight on African talents wey be ogbonge for di industry.

Who host di red carpet

For di 2024 edition of di AMVCA, na Sir Uti, Toke Makinwa, Sika Osei and VJ Adams bin dey wit celebrities and guests for di red carpet as host.

Di three of dem entertain guests, nominees and oda celebrities for di red carpet.

Highlights

Na 26 categories dem award for dis year AMVCA.

As di show dey begin, Govnor Babajide Sanwo-Olu bin give im speech wia im salute di organisers for sustaining di award for ten years.

Lagos na di host state for ova di years and Govnor Sanwo-Olu say dem get plans for plenti projects wey go help di entertainment industry.

Anoda highlight for di night na di dance show wia di host IK bin call some actors to come follow am dance di stage.

Kunle Remi, Olumide Oworu and Tobi Bakre dey among di actors wey come on stage to dance but you fit trust say dia dance no go pepper body.

Past winners and nominations

Collage picture of Osas and Tobi Bakre

Wia dis foto come from, Africa Magic

Tobi Bakre -win Best Actor for di movie Brotherhood while Osas Ighodaro bin win Best Actress for di movie Man of God.

Kunle Afolayan- win Best Overall movie wit im feem Anikulapo.

Movies wey get di biggest nominations for di 2023 AMVCA na Anikulapo wit 16 categories, while Brotherhood and Shanty Town enta 11 categories each.

Kunle Afolayan Anikulapo, King of Thieves by Femi Adebayo, Jade Osiberu Brother, and Funke Akindele Battle on Buka Street make di list for Best Overall Movie alongside three oda movies.

For di 2022 edition of di AMVCA, ogbonge actor Stan Nze win di Best Actor category for Drama while actress Osas Ighodaro bin win di best Actress for Drama.

Oda winners for drama category include Timini Egbuson, Toyin Abraham.

2020

Ramsey Nouah feem, Living In Bondage: Breaking Free, pack seven awards on for di seventh edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards.

Na di first time Ramsey Nouah wey follow win di Best Director award for im work dat year, go direct a movie.

Di movie also win Best Sound Editor, Best Cinematographer, Best Soundtrack, Best Writers, Best Movie for West Africa and Best Overall Movie.

Two Big Brother Naija celebrities, Neo Akpofure and Venita Akpofure win Best Dressed

Wia dis foto come from, X/DstNigeria

Wetin we call dis foto, Neo and Venita win Best Dressed Male and Female at di Cultural day